language string | goal string | solution0 string | solution1 string | label int64 |
|---|---|---|---|---|
Nigerian Pidgin | How pesin fit stop make accident no happen for road? | Driver no suppose dey drink alcohol when e dey drive. | Driver fit close eye small for steering if e don tire | 0 |
Nigerian Pidgin | How pesin fit dey save money small small | Make pesin dey keep small small money for bank. | Make pesin dey buy everything e see for market | 0 |
Nigerian Pidgin | How una fit stop make malaria dey catch pesin for Nigeria | make pesin dey chop plenty sugar, malaria no go catch ham. | make dem dey sleep under mosquito net wey get medicine every night. | 1 |
Nigerian Pidgin | How pesin fit cross road correctly? | Make pesin shadow very well look right din left again before crossing. | Close eye run cross quickly. | 0 |
Nigerian Pidgin | If you buy plenty oranges for market and you wan carry dem go house, which one go dey okay? | Put di oranges inside basket | Put di oranges inside one small nylon | 0 |
Nigerian Pidgin | You dey second flour of a three storey building and you wan come down, wetin make sense pass? | Use di stairs wey dem build inside house | Use di long ladder wey dey beside di house | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan sew button for your shirt, wetin you suppose use? | Pass thread inside small office pin and use am sew. | Pass thread inside small sewing needle and use am sew. | 1 |
Nigerian Pidgin | Best way to find needle wey lost for ground na | to use torchlight find am small small | to use water bottle find am small small | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan carry small drinking water go your workplace, which one go fit well for your bag? | Iron water kettle wey get cover | Plastic water bottle wey get cover | 1 |
Nigerian Pidgin | You wan dance video content outside, which tripod you go use? | Adjustable tripod wey get three steady legs | Adjustable tripod wey di legs dey shake | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan enter hospital ward, which kain mask you suppose use? | Medical face mask | Carnival face mask | 0 |
Nigerian Pidgin | Your phone battery don enter red, wetin you go use charge am? | You fit use phone earpiece wey get correct cable | You fit use phone charger wey get correct cable | 1 |
Nigerian Pidgin | If you wan cut fabric wey you wan sew, wetin you go use? | Scissors wey sharp well well | Knife wey sharp well well | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan type document, wetin you go need? | you fit use computer type di document | you fit use television type di document | 0 |
Nigerian Pidgin | Your phone battery don low, wetin fit help you? | electric lamp dey okay | powerbank dey okay | 1 |
Nigerian Pidgin | You wan travel go community where light no dey to charge, wetin you suppose to add to your luggage? | torchlight wey you don charge well well | powerbank wey you don charge well well | 1 |
Nigerian Pidgin | You baff finish, wetin you go use dry your body? | use towel dry your body well | use bedsheet dry your body well | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan collect money for bank machine, wetin you go use? | if you put ATM card, di machine go give you money | if you use library card, di machine go give you money | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan move arrow for computer screen, how you go do am? | you fit use remote control move di arrow go anywhere | you fit use mouse move di arrow go anywhere | 1 |
Nigerian Pidgin | After you chop food finish, how you fit wash di dirty plates? | Put am inside dishwasher | Put am inside washing machine | 0 |
Nigerian Pidgin | If you wan chop onions to cook, wetin you go do? | you go use sharp knife slice di onions | you go use hand tear di onions into pieces | 0 |
Nigerian Pidgin | Which option better if you wan blend pepper? | you go put di pepper inside bucket, con shake am well well | you go put di pepper inside blender, con grind am | 1 |
Nigerian Pidgin | Your clothes don doti, how you fit wash dem clean? | put di clodis inside water, add soap join, con scrub di clothes | put di clothes inside water, spray perfume on top am, con scrub di clodis. | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan waka cross busy road, how you fit do am safely? | you go close your eyes con run fast cross road | you go look left and right, wait make make motor stop before you run fast cross di road. | 1 |
Nigerian Pidgin | You wan brush your teeth for morning, wetin you go use? | you go use toothbrush and toothpaste clean your mouth | you go use sponge and tomato paste clean your mouth | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan soak garri , wetin you fit add inside make e sweet? | add sugar and groundnut inside di garri | add sand and small stone inside di garri | 0 |
Nigerian Pidgin | As meeting don start for Google Meet, wetin you go press make dem fit hear you? | you go press unmute button talk | you go press sharescreen button talk | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan save new number for your phone, wetin you go do first? | open gallery app wey dey your phone | open contact app wey dey your phone | 1 |
Nigerian Pidgin | You dey search something for google, but di page no dey load, wetin you go check first? | you go check if bluetooth dey on | you go check if data dey on | 1 |
Nigerian Pidgin | If pesin dey apply for job, one ogbonge document wey hin suppose attach to di email na? | hin suppose attach CV | hin suppose attach school handout | 0 |
Nigerian Pidgin | You dey fry plantain, wetin you take turn am for hot oil? | E better to use broom | e better to use frying spoon | 1 |
Nigerian Pidgin | If you wan iron your school uniform, wetin you go plug for light? | you go plug pressing iron | you go plug washing machine | 0 |
Nigerian Pidgin | Driver wan carry 15 passengers from Lagos go Abuja, which option make sense pass? | na bus dey okay | na bicycle dey okay | 0 |
Nigerian Pidgin | Doctor wan check wetin dey sup for im patient chest | im go use speaker listen | im go use stethoscope listen | 1 |
Nigerian Pidgin | You wan login to your email for your new laptop, wetin you go type? | you go type your email address and your password | you go type your house address and your password | 0 |
Nigerian Pidgin | Contractor wan build house wetin be di first thing dem go first do? | Dem go just start to dey mount block direct. | Dem go lay plan first con do foundation | 1 |
Nigerian Pidgin | You go safari you con see lion dey come your side wetin you go do? | Na to first run go stay for where safe | Try wait make di lion catch you first | 0 |
Nigerian Pidgin | Fuel finish for your car for road wetin you go do? | Find how you go take buy fuel put for di car | Try find better water wey cold well well pour for di car | 0 |
Nigerian Pidgin | You and your guys wan write exam wetin you suppose dey do? | Try dey sleep and make una try play wella before una start di exam | Una go gaz read wella before di exam go start | 1 |
Nigerian Pidgin | Rain dey fall, you wan comot wetin you carry? | You carry umbrella take cover your head | You go carry television put for head | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan chop rice, wetin you go use cook ham? | You go spread ham for sun make e done. | You go boil ham with pot for fire | 1 |
Nigerian Pidgin | Nepa carry light for your house, wetin you fit use see road? | You go use pressing iron see road | You go on torchlight use see road | 1 |
Nigerian Pidgin | You dey work you con dey sweat wetin you go use wipe your face? | You go use handkerchief wipe ham | You go use sandpaper wipe ham | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan bath wetin you go need? | You go need soap and water | You go need stone and sand | 1 |
Nigerian Pidgin | You put soup for fire di fire don too much wetin you go do? | You go pour kerosene join ham | You go gaz low di fire | 1 |
Nigerian Pidgin | Weather hot and your body dey hot join wetin fit cool your body down? | You go use cold water bath make your body fit cool down | You go wear winter jacket | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan clear your compound bush wetin you go use? | You go use cutlass take run ham | You carry spoon take run ham | 0 |
Nigerian Pidgin | You dey road motor dey come wetin you go do? | You go stand gidigba make e jam you | You go run comot road | 1 |
Nigerian Pidgin | You dey for sun e too hot wetin you go fit do? | You go find shade stay | You go wear sweater con sit for sun | 0 |
Nigerian Pidgin | You dey atm machine, machine swallow your card wetin you fit do? | Report to di bank staff or call customer care immediately | Carry stone knock di atm machine make di card comot | 0 |
Nigerian Pidgin | Rain fall everywhere con dey muddy your white sneakers stain wetin you fit do? | throway di sneakers because say e don stain | Comot di stain with water and soap after you don reach house | 1 |
Nigerian Pidgin | You dey inside taxi, driver dey overspeed for express. Wetin you suppose do? | Follow driver talk make e slow down | Clap for di driver tell ham say em dey try | 0 |
Nigerian Pidgin | Phone fall for water for your hand wetin you go do? | Comot battery/sim con dry ham or put inside dry rice or carry ham go repair | On di phone immediately con start to dey press ham | 0 |
Nigerian Pidgin | You notice say your body dey tire you con dey feel like say you dey sick wetin you go do? | Start to dey jump up and down still dey run join | Sharply enter hospital go complain give your doctor | 1 |
Nigerian Pidgin | You buy phone online but di one wey dem bring no be wetin you want how you go do ham? | Contact seller or support team follow dem talk make dem know say mistake don dey | Keep quiet continue to dey use ham like that | 0 |
Nigerian Pidgin | You dey write business proposal you con mistakenly delete important document | No bodir continue di proposal as per say you don delete something | Check recycle bin if you go fiit see wetin you delete | 1 |
Nigerian Pidgin | You wan travel you dey park you con see say driver dey drink alcohol wetin you go do? | No worry yourself as di driver don talk say e fit handle ham | No enter di bus report ham or try find anodir park go enter bus | 1 |
Nigerian Pidgin | You wan write project report for NGO wey you dey work but your laptop suddenly stop to dey work and deadline dey tomorrow wetin you go do? | Find anodir laptop borrow or try check cyber cafe make you finish di work so that you go fit quick sumit | Wait make your laptop repair first even if deadline go pass | 0 |
Nigerian Pidgin | Your guy tell you make you invest for em farm business but him no get better plan or budget how you go do ham? | Tell ham make em write proposal with clear plan join ham before you go fit decide | Drop money sharp sharp because say na your padi no bodir ask ham quesion | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan drink water for kitchen, wetin you use hold am? | You go use cup hold am | You go use comb hold am | 0 |
Nigerian Pidgin | Your hair don rough, wetin you go use arrange am? | You go use calculator arrange am | You go take comb arrange am | 1 |
Nigerian Pidgin | Baby get fever, wetin nurse go use check temperature? | nurse go use dirmometer | nurse go use screwdriver | 0 |
Nigerian Pidgin | Small pikin wan pack him school things before class start | E go put books inside school bag | E go put books inside nylon | 0 |
Nigerian Pidgin | Woman wan arrange clodis wey she iron finish make dem no scatter | she fit hang dem for hanger | she fit hang dem for rope | 0 |
Nigerian Pidgin | Tailor wan put corset for cloth, wetin e go use? | Him fit use flower | him fit use rigilene boning | 1 |
Nigerian Pidgin | Some of di major ingredients you go need to cook correct jollof rice for Sunday lunch na | Rice, pepper, tomato, and oil na some of di things wey you go need | Rice, pepper, tomato, and soap na some of di things wey you go need | 0 |
Nigerian Pidgin | Wetin be di correct step to boil yam make e soft? | peel di yam, wash am, put am for pot, add detergent din cook | peel di yam, wash am, put am for pot, add water din cook | 1 |
Nigerian Pidgin | Pesin wan clean rug for living room, make e shine well well | pesin fit use chair cleaner comot all di dirty | pesin fit use vacuum cleaner comot all di dirty | 1 |
Nigerian Pidgin | Tailor dey sew plenty gown, which option dey faster? | Sewing machine dey faster | Needle and thread dey faster | 0 |
Nigerian Pidgin | Wetin be di correct way to prepare tea? | Boil water, pour am for cup, add salt, din put sugar | Boil water, pour am for cup, add milk, din put sugar | 1 |
Nigerian Pidgin | Before you comot house go event, wetin you go use check your clodis and face? | you go look yourself for mirror | you go look yourself for frying pan | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan know time wey you go reach office, wetin you go look? | you go check your wristwatch | you go check di sky | 0 |
Nigerian Pidgin | You get test for school next week, wetin you go do? | you go read storybooks | you go read school books | 1 |
Nigerian Pidgin | Sun dey shine, you no want make e enter your eyes? | you go wear cap | you go wear sweater con sit for sun | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan store your clodis neatly for bedroom, where you go keep dem? | you go keep dem inside fridge | you go keep dem inside wardrobe | 1 |
Nigerian Pidgin | You wan pay NEPA light bill, how you fit pay am? | I fit use my bank mobile app | I fit use my music player app | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan cook rice sharp sharp, wetin you go use? | I go put am for electric rice cooker. | I go put am for nylon bag under sun. | 0 |
Nigerian Pidgin | Rain don fall, your cloth no dry finish, how you go dry am quick?" | I fit use pressing iron small to dry am. | I go put am inside fridge. | 0 |
Nigerian Pidgin | Mosquito dey disturb you for night, how you go take rest well? | I go wear winter jacket. | I go use mosquito net. | 1 |
Nigerian Pidgin | You wan chop eba, how you go take prepare am? | I go pour garri inside hot water. | I go pour garri inside kerosene. | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan start generator, wetin you go need first? | I go put groundnut oil for tank. | I go put petrol for tank. | 1 |
Nigerian Pidgin | Breeze blow break window glass, wetin fit hold am for now? | I fit cover am with cooked rice. | I fit cover am with carton. | 1 |
Nigerian Pidgin | Your shoe lace cut for road, wetin you go use tie am? | I go use banana peel. | I go use small rope. | 1 |
Nigerian Pidgin | You wan drink cold water for hot afternoon, wetin you go do? | I go put bottle water for freezer. | I go put bottle water for fire. | 0 |
Nigerian Pidgin | Your key no gree turn for padlock, wetin fit free am? | I go rub toothpaste. | I go rub small engine oil. | 1 |
Nigerian Pidgin | You wan repair bicycle tire wey flat, wetin you go do? | I go pump am with air. | I go pour water inside am. | 0 |
Nigerian Pidgin | Your table dey shake, wetin you go put under leg? | I go put cardboard to use hold di leg. | I go put tomato stew to use hold di leg. | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan fetch water from well, wetin you go use? | I go use bucket and rope fetch am. | I go use nylon bag fetch am. | 0 |
Nigerian Pidgin | Your cloth stain with oil, wetin you go use wash am? | I go use detergent clean am. | I go use sand clean am. | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan travel for long journey, wetin you go carry your load with? | I go put am inside plate. | I go put am inside travelling bag. | 1 |
Nigerian Pidgin | Your food too pepper, wetin you fit add make e calm down? | I go add engine oil use make am calm down. | I go add small palm oil use make am calm down | 1 |
Nigerian Pidgin | Your hand dirty after chop suya, wetin you go do? | I go wash am with water and soap. | I go wipe am for sand. | 0 |
Nigerian Pidgin | Your phone screen dirty, wetin you go use clean am? | I go use soft cloth use clean am. | I go use razor blade use clean am. | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan measure pepper for market, wetin you go use? | I go use cup use measure di pepper. | I go use stone use measure di pepper. | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan drink coke cold, wetin you go do? | I go put am for fridge make e cold well well. | I go put am for fire make e cold well well. | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan check news online, wetin you go on? | I go on phone data make I fit check news online. | I go on standing fan make I fit check news online. | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan make puff-puff, wetin you go mix? | I go mix stone and sand use make puff-puff | I go mix flour, yeast and water use make puff-puff. | 1 |
Nigerian Pidgin | You wan fry akara, wetin you go need? | You fit use frying pan and oil fry akara. | You fit use shoe polish fry akara | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan build small bench, wetin you go use join wood? | I go use nail join di wood. | I go use chalk join di wood. | 0 |
Nigerian Pidgin | You wan waka for night, wetin you go carry? | I go carry fan use waka for night. | I go carry torchlight use waka for night. | 1 |
Subsets and Splits
No community queries yet
The top public SQL queries from the community will appear here once available.